Friday, 8 March 2013

Yobo and Keshi


Keshi don tok why he no carri Yobo


Coachi of Naija Supa Eagus, Stephen Keshi, don yarn guymen why hin no gree carri Yobo for match wey Naija wan play Kenya for Calabar.

Keshi bin do naming ceremony on Thursday, for playa dem wey dey tap dia ball for obodo oyibo and wey go follow Kenya play, but Yobo name no bin dey inside.

"I no tink say dis match hard reach to carri Yobo. Hin na beta baller, as evribodi sabi, but we no need am for dis match," Keshi yarn we for supersport.com on Friday.

Many guymen go still raise eye sha, bicos Yobo bin tap faya on Thursday, wen hin club, Fenerbahce (dem dey play for inside Turkey) waya Viktoria Plzen 1-kondo for Europa lig.

Yobo na de Naija playa wey don tap ball for Supa Eagus pass (he don tap for Naija 95 times na) and na onli five match remain to reach 100.

Naija go follow Kenya play for March 23, inside Calabar, as contri dey fite enta Brazil for World Cup nes year.

by Temisan Okomi

No comments:

Post a Comment