| Frank Lampard |
Chelsea chief executif Ron Gourlay no go join mouth for the mata as per all the tok tok wey dey town say weda midfilda Frank Lampard go stay for the Europe champion bakyad, abi in go kuku waka, wen in kontrak kpai for June, the klub bin yarn for Tuesday.
Media repot bin quote say Gourlay tok say dem still dey yarn as per new deal wey Chelsea dey try yarn with Engalnd Lampard, wey b 34 years.
Lampard wey join the klub for 2001 don dey shine anyhow dis seasin, and na onli four gols remain make in score take become the Premier Lig klun rekod gol scora. The midfilda form don pik well well since in come bak from injuri wey bin dey wori am for Decemba, as e come b fans dem don dey para say make the klub gif am new kontrak.
"I no wan yarn any mata now," qoute wey comot for Chelsea website (www.chelseafc.com) yarn, as in dey yarn for Thailand were in dey prepare for the pre-seasin parole wey the London klub dey plan for dat side.
"We no wan make pipu sabi wetin we dey yarn bitwin the klub and the playa now, na wetin i fit yarn for now sha."
No comments:
Post a Comment