![]() |
| Real Madrid |
The tin b like magic no b small, The Portugal strika become the fes playa to score for six strait 'Clasico' away from in house. Gerard Pique bin foul the guyman inside eitin, and in sef gada bodi, stand up, hama korrect penarity pass Jose Manuel Pinto wey dey Barca post for the 13 minut.
As per normal normal, na Barca dominate ball, but dem no too wori Madrid defence sef, and Ronaldo sef come show insef, as in run hama Di Maria rebounce wey fall for in road, pass Pinto for the 57 minut.
Na the numba 12 gol wey in don score for the 18 times wey in don play Barca since in enta Madrid for 2009, and also, na the secon time in dey score two gol for the lass teo match wey in don play for Nou Camp b dis.
Real come do Barca strong tin, add salt on top injuri as dia defenda Raphael Varane, wey bin equalise for the fes leg wey dem play for Bernabeau, nod beta nodding for the 68 minut enta Barca net from kona kik wey Madrid take.
Barcelona kontinu to dey press, but dem bin no fit Madrid defense as Jose Mourinho, siddon for bench dey jolly as in boys dey cari Barca do oyoyo for am.
Barca manaj comot small shame for face as Jordi Alba score for dem for the 89 minut, but upon all the gre gra time bin don pass and notin wey Barca fit do, and na the fes time Barca chop gols for house agains Real since the 3-3 draw wey dem play for March 2007

No comments:
Post a Comment